E DEY SHOKOTO by Faith Edoja

I for travel go sokoto,
dem say money dey dere like river koto,
i for go Benin,
dem say for dere i fit
go obodo oyibo.

I go go Ghana,
dem say you fit make am dere even if you dey sell gala,
i go the other side,
na there the grass for green pass, na there wide.

Tell mama say i don turn oyibo,
i no black again, thank onyigbo,
tell papa say i don bekom oga,
make e stop dey give me oda.

You won fine, go ripe like dodo,
you come back but nobody know you for the obodo,
i no fit wake loss dey fine money,
i nor go go far find my honey.

The true be say,
watin we dey fine for sokoto,
dey here for our shokoto.

Popular Posts